3 Yu make human being go back to san where Yu from kreate dem wen Yu sey, “Make una go back to where I for kreate una!”
Yu go sweat before yu chop, until di day wey yu go die go back to groun, where I from kreate yu.”
bikos na God hand dey hold di eart and evribody dey alive bikos of en pawa.
Wen Yu nor ansa dem, dem go dey fear. Wen Yu remove life from dem, dem go die kon turn to san.
Wen dem don die, dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem.
By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.
Mi God don sey, ‘I go do wetin I tell dis wiked pipol wey gada togeda against mi. All of dem go die for dis wildaness. Mi wey bi God, don tok.’ ”