Dem nor tell yu sey na mi plan all dis tins before dem happen? I don do as I plan dem. Na mi give yu pawa to turn towns wey dem guide well-well, to where dem dey trowey dirty put.
Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.
Den my enemies go si sey God dey for my side and shame go katch dem. Dis na di same enemies wey ask sey, “Where dat yor Oga God dey?” And naw, I go si as dem dey fall and I go mash dem pass like portor-portor for road.
Wen Israel men wey dey di valley and di oda side for Jordan River si sey all Israel men don die and Saul and en shidren don die too, dem kon run komot di town. So Filistia sojas kom take-ova di town.