3 bikos as my enemies si Yu, dem stagga fall kon die.
No wonder dem dey fear Yu well-well! Na who fit stand for yor front wen Yu dey vex?
Make awa enemies nor chop and burn us finish. Make dem die, bikos Yu nor dey happy with dem.
If una make God di place where una dey hide put; if una make di Most High God where una dey stay,
For morning, e dey good to tok about yor love wey nor dey fail and for evening, wi go sing of yor faithfulnes,
bikos wen Yu do tins wey wi nor espect; wen Yu kom down, di pipol kon dey fear. Wen di mountins si Yu, dem bigin shake dey fear.
God go distroy dem and dia ponishment nor go ever end. Wen Christ go kom receive glory from di pipol wey e choose,
Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.