2 I go sing with joy bikos of Yu. Di Most High God, I go sing praiz yor name,
My God, I tank Yu with all my heart; I go sing yor praiz for where evry oda gods dey.
kom tank and tell Yu about all di wonderful tins wey Yu don do.
Den I go win my enemies wey gada round mi! I go offa sakrifice for dis temple and shaut for joy! I go dey sing and praiz my Oga God.
Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart. My heart dey happy well-well, bikos God help mi. So, I go always dey sing dey tank am.
For der, I go-go God altar; di God wey dey give mi joy kon praiz am with my harp!
But make doz wey Yu dey guide, always dey happy! Make dem always dey shaut for joy! Guide dem, so dat doz wey loyal to Yu, go happy!
So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.
Den dem go know sey na only Yu bi God, di Pesin wey get pawa pass for di whole world.
My Oga and God, I go praiz Yu with all my heart, I go give glory to yor name forever,
E dey good to tank God. Yes! Awa belle dey sweet us wen ever wi dey sing and praiz di Most High God.
My God, Yu dey make mi happy bikos of evritin wey Yu do and I go sing praiz Yu, bikos Yu dey good to mi.
Make una rite di wonderful tins wey E do among di nashons. Make una tell evribody about di good-good tins wey E do.
So make evribody wey dey fear God, happy kon praiz en holy name!
Yu, God get pawa pass evritin for dis world; so dem go praiz Yu pass any oda god.
Di Most High God make yor papa Nebukadnezzar get kingdom wey strong well-well and E give yor papa respet, honor and majesty.
Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!