Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 9:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 But God nor go forget doz wey dey kry for help. E nor go live dem forever; E go always dey give poor pipol hope.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 9:18
15 Iomraidhean Croise  

Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.


to hear di prisonas kry for help and to release doz wey dem won kill.


bikos E dey protet pipol wey nor get, so dat E go save dem from wiked pipol wey won kondemn dem.


So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”


My God, I wish sey Yu go just kill wiked pipol finish! So make wiked pipol leave mi alone o-o!


All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.


bikos na only Yu bi my hope and na from wen I bi small pikin, I don dey trust Yu kom rish naw.


E go defend doz wey dem dey opress among di pipol, diliver poor pipol shidren and distroy doz wey dey opress pipol.


Bikos di Pesin wey dey ponish doz wey kill pipol, still dey kare for doz wey nor get helpa. E nor dey leave pipol wey dey sofa.


If e bi like dat, den yor future go dey sikure.


na so wisdom dey good for di soul. Make yu get wisdom and yor future go dey sikure.


E don make doz wey dey hongry beleful with good food and pipol wey get money well-well, E don make dem poor.


Den Jesus look en disciples, tell dem, “Make una happy, una wey dey poor, bikos na una get God Kingdom.


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan