Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 9:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Wiked pipol go die enter grave. Dis na wetin go happen to all di pipol wey rijet God.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 9:17
22 Iomraidhean Croise  

E dey katch pipol wey feel sey na dem get sense pass kon end dia wayo work.


Pipol wey nor dey fear God bi like di reed; dia hope don go as dem just forget God.


But si as dem kwik forget wetin God do! Dem nor gri listin to en advise!


Even doh all dis tins dey happen to us, wi neva forget Yu. Wi neva go against yor kovenant.


If wi don rijet awa Oga God kon dey pray to anoda god,


Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dia grave; di place where Deat go bi dia shepad and oga. For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem. Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.


All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.


Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.


Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.


But evil pipol own don finish, bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.


Deat go open en mout wide dey wait dem and all di big and betta pipol with doz wey dey celebrate for Jerusalem, go soon enter deat mout.


E sey dis na wetin go happen to una, bikos una forget am kon trust lie-lie gods.


But my pipol don forget mi, dem dey burn incense give juju and na dis make dem fall komot for di way wey dem suppose follow. Dem nor dey follow di road wey I show dem, instead dem dey follow di road wey nor smooth at-all.


Yong woman dey forget to wear en gold ring? Abi woman wey won marry, dey forget to wear en marriage klot? But e don tey wey my pipol don forget mi.


“I dey hear one nois on-top di hill: Na Israel pipol dey kry and beg dia juju. True-true, dem dey stay inside sin and don forget di Oga wey bi dia God.


So di oda nashons nor go respet una and una go know sey na mi bi God.”


I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. Mi, wey bi God, don tok.


Anybody wey dem nor si en name inside di Life Book, dem go trowey am inside di big fire.


But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan