But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.
Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world; di tribe wey Yu take as yor own! Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay.
bikos God dey kom from where E dey stay for heaven kon ponish pipol bikos of dia sins. Di eart go show all di innocent pipol blood wey dem share on-top am and e nor go ever forget di innocent pipol wey dem kill.
So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.