Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 89:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Even angels dey honor am wen dem gada togeda and E great pass evribody wey dey round en throne.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 89:7
17 Iomraidhean Croise  

Bikos di Most High dey good! Na-im bi di great King for di whole eart.


E nor get who nor dey fear Yu, bikos na Yu kreate evritin. Nobody bi like Yu for di whole world. Even kings and wise men nor rish Yu.


Fear katch di pipol for di church and odas wey hear wetin happen.


Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire.


But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.


Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.


Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.


Make all di angels for heaven honor God; make una honor am, bikos of en glory and strent.


My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!


Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne?


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


Who dem go fit use take kompare God? E get anybody wey bi like am?


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan