3 bikos na so-so trobol full my life and deat don near mi well-well.
Dem go soon go join dead body. Deat angel dey wait for dem.
Dem nor even fit chop and na die remain for dem to die.
Di waves karry di ship up-and-down for di sea and doz wey dey drive di ship fear well-well, bikos of di great wahala wey di wave dey kause.
My Oga God, make Yu hear my kry for help, den judge my kase. Listin to my prayer, bikos na trut I dey tok.
Wen I dey trobol, I look for God. Thru-out di nite, I pray and lift my hand go heaven, but nor-tin fit konfort my soul.
Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.