12 My Oga and God, I go praiz Yu with all my heart, I go give glory to yor name forever,
Awa God, wi tank and praiz yor name wey get pawa.
Den David kommand en pipol, “Make una praiz di Oga wey bi una God!” And all di pipol praiz di Oga wey bi dia papa God kon bow honor en and di king.
So I go sing to God as long as I dey; I go sing praiz to my God as long as I dey breath!
I go always dey praiz God. I go always dey tok about all di good tins wey E dey do.
My God, I go tank Yu with all my heart; I go tok about all di wonderful tins wey Yu don do.
I go sing with joy bikos of Yu. Di Most High God, I go sing praiz yor name,
For dat time yu go sey: “Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi, but naw, Yu dey konfort mi and Yu nor dey vex again.
As dem dey go, dem kon rish where wota dey, naim di man sey, “Si, wota dey here! Wetin go make mi nor baptize naw?”
so dat as una dey togeda, una go fit use one vois praiz God, wey bi awa Oga God Jesus Christ, Papa.
But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God.
God don pay betta prize for una, so make una honor am with una body.
Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms.
So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.