Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 86:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God, make Yu hear my prayer; make Yu ansa and help mi, bikos pipol dey opress mi.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 86:1
19 Iomraidhean Croise  

But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.


My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!


Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.


So make Yu nor let dem laf and curse mi, bikos I dey obey yor kommand.


But I know sey God go help di pipol wey dem dey opress kon judge well for poor pipol.


I kry to God! I dey beg make E kom help mi.


My God, I dey pray to Yu, bikos I know sey Yu go ansa. Abeg, make Yu listin to mi as I dey pray.


Make Yu turn kon sorry for mi, bikos na only mi dey and I dey sofa well-well.


Make Yu listin to mi kon kwik diliver mi. Make Yu bi my rock wey go dey protet mi; di strong place where I fit hide put.


I pray to God as I dey sofa and E ansa mi; E save mi from evritin wey dey worry mi.


I dey poor and I nor get anytin, so make God keep mi for en mind. My God, make Yu kwik kom, bikos na Yu bi my help and di Pesin wey go save mi.


Naw, my Oga God, make Yu hear and si wetin dey happen to us. Make Yu listin to all di tins wey King Sennakerib dey use take curse Yu wey bi God.


Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.


Abeg, God make Yu sorry for Jerusalem town wey Yu choose, nor bi bikos wi deserve am, but bikos of yor great love wey nor dey fail.


“God go bless una wey dey poor for spirit, na una go get heaven.


“God Spirit dey my body, bikos E don anoint mi make I prish Good News give poor pipol. E send mi make I prish freedom give pipol wey dey prison and make blind pipol for si. E still sey make I free doz wey dem dey opress


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan