I hear Israel pipol dey tok with pain sey, “Oga God! Wi bi like animal wey dem nor train, but Yu don tish us to dey obey. So make Yu bring us kom back, bikos wi dey ready to kom meet Yu di Oga wey bi awa God.
Before-before, Yu dey defend us. So make Yu nor vex for Jerusalem again, bikos na yor town and holy hill, e bi. Doz wey dey stay near us, dey look Jerusalem kon dey laf yor pipol, bikos of awa sin and di wiked tins wey awa grand-grand papa dem do.
I nor go ponish una, bikos I dey vex; I nor go distroy Efraim again, bikos I bi God and I nor bi man. Mi wey dey holy, dey with una. I nor go vex kom meet una.