6 Dem wey gada so na: Edom and Ishmael pipol, Moab and Hagrit pipol;
For di time wen Saul bi king, Reuben tribe attack and kill Hagrit pipol for war, den dem take dia land for di east side for Gilead.
Afta, Moab and Ammon pipol with some pipol from Meun kon attack Jehoshafat.
My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”
Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.
Moab go skata and nobody go know am again, bikos God don curse am.
King Eglon join Ammon and Amalek pipol kon fight and win Israel pipol, den dem take Jeriko town wey palm tree full.