Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 83:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God, make Yu nor kwayet just like dat! Make Yu nor rijet us! Nor just do like sey e nor koncern Yu!

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 83:1
7 Iomraidhean Croise  

I dey pray to Yu, my God wey bi my rock. Make Yu ansa mi. Bikos if Yu kwayet, life go taya mi and I go kwik die.


My God, Yu know all dis tins. So, make Yu nor just keep kwayet, make Yu nor live mi naw.


So, my God, make Yu wake-up! Wetin make Yu dey sleep? Make Yu get up! Make Yu nor rijet us forever.


Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.


Awa God dey kom and E nor dey kwayet at-all. Fire dey burn evritin wey dey en way and strong breeze wey dey make nois, dey round am.


God sey, “I kwayet since and I nor ansa my pipol, but di time to tok, don rish. Just as woman wey won born dey shaut, na so too I dey shaut naw.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan