Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 82:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 But doz wey dey opress oda pipol, nor know anytin at-all. Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness, while all di foundashon for di eart dey skata.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 82:5
19 Iomraidhean Croise  

bikos dis life wey wi dey so, short well-well. Wi nor know anytin at-all and awa days for dis eart bi like shadow wey go kwik vanish.


So, naw wey di foundashon don skata, wetin good pipol go fit do?”


Doz wey dey do bad nor go ever learn? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor dey pray to God.


Pipol wey dey do wiked tins nor get sense at-all? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor ever dey tink sey e good make dem pray to God.


Di eart go shake and evribody go fear, bikos na mi make di foundashon.


Na God bi king! Make di nashons shake with fear! E sidan for en throne where di angels wey get feadas dey and make di eart shake.


Una nor ever get wetin to do with wisdom and una nor gri obey God.


From pipol wey live good life before dem bigin do bad-bad tins;


But wiked pipol road dark well-well; dem go fall and dem nor go si wetin make dem fall.


Wise pipol dey si where dem dey go, but foolish pipol dey waka fall for darkness. But I still si sey, both wise and foolish pipol dey sofa di same tins.


I still si sey, for dis world, yu go si wikedness for where good judgement and rite pipol suppose dey.


Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.


Di pipol sey, “Na naw wi know why God nor save us from doz wey dey opress us. Wi dey hope sey wi go si lite, but na only darkness wi dey si


I sey, “Una wey bi leaders for Israel, make una listin! Na una suppose know good from bad,


Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.


Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


But di one wey hate en broda or sista for Christ, dey for darkness and e nor know where e dey go, bikos darkness don blind en eye.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan