Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”
Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.
“Make una listin to wetin mi wey bi God dey tok. Make una make sure sey dem dey always give korrect judgement for kourt. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am and bikos of di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire wey nor dey kwensh.
Dis na wetin God tok: “Make una do wetin dey good and korrect. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am. Make una nor trit or opress strenjas; doz wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die and make una nor kill innocent pipol for dis land.
Dem don fat and dey chop betta food. Dem nor know wen to stop all di bad tins wey dem dey do. Dem nor dey give doz wey nor get papa dia rite or give betta judgement to doz wey dem dey opress.
Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.
Una must judge well for di strenjas wey dey with una; doz wey nor get papa and mama and woman wey en husband don die. Make una nor ever take dia klot as shorti for debt.
But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.