“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.
Moses pray for Levi tribe sey: “My God, Yu don give yor Tumin and Urim to doz wey dey fear and respet Yu. Doz wey Yu don test for Massah kon follow dem kworel for Meribah wotaside.