But dem nor gri listin or hear mi. Dem dey do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do. Instead make dem dey betta, dem kon worse pass as dem bi before.
“O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am.