Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 81:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do kon live dia life di way dem wont am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 81:12
20 Iomraidhean Croise  

So Oga God kon sey, “My Spirit nor go fit stay with man again pass one hundred and twenty years, bikos dem bi ordinary human being.”


Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga wey bi dia God kon break di agriment wey dem make. Dem nor gri listin or obey evritin wey God kommand dem thru Moses, en savant.


But bikos of pride and sturbones, awa grand-grand papa dem nor gri obey yor kommand.


Yor shidren go don sin against God, naim make am pay dem for dia sin.


God kon tell Moses, “Fero nor go gri listin to yu, so dat I go fit do my plenty wonders for Egypt.”


God sey, “I go ponish my shidren wey nor dey obey my kommand. Pipol wey dey do wetin dem like and enter agriment with wiked pipol kon dey do tins without my Spirit. Dem just dey add join dia sins.


Bikos dis pipol sturbon and dey lie well-well; dem bi shidren wey nor gri obey God law.


Who sell Israel give di tif dem? Na God ensef wey wi sin against! Wi nor dey live awa life just as E wont or obey wetin E tish us.


And naw, I don tell una, but una nor one gri do evritin wey God sey make I tell una.


But dem nor gri listin or hear mi. Dem dey do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do. Instead make dem dey betta, dem kon worse pass as dem bi before.


But dem rijet mi and nor gri listin to mi. Dem nor gri trowey dia juju or stop to woship Egypt gods and naw, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish.


God wey I dey serve go rijet en pipol, bikos dem nor gri listin to am and dem go dey waka up-and-down for difren kountry.


God kon tell dem, “If una nor obey my kommand, I go ponish una.


Before-before, E let difren tribes dey do as dem like,


“God leave dem make dem woship stars to make wetin Profet Amos tok, happen sey, ‘Israel pipol, una tink sey na mi una dey serve wen una dey sakrifice animal for inside wildaness for forty years?’


So God don leave wiked pipol make dem dey do di bad tins wey dia mind, wey bi sey man dey sleep with man and woman dey sleep with woman.


But di pipol still sey dem wont king. Dem nor gri listin to di warnin wey Samuel dey give dem.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan