3 My God, make Yu bring us back to yorsef again. Make yor face shine upon us again and na only den wi go get rest of mind.
My Oga God! Make Yu ansa mi! Ansa mi, so dat pipol go know sey na Yu bi di true God, den dem go turn from dia sins kom meet Yu.”
Make Yu look mi with love kon tish mi yor laws.
Many pipol dey sey, “Who go fit show us wetin dey good?” So my God, make Yu smile for us.
My God, Yu don rijet and skata awa defence, bikos Yu dey vex for us. But naw, make Yu kom favor us again.
Make God show us en favor and bless us! Make E always dey happy with us!
Di Shepad for Israel, make Yu listin to us. Yu wey dey kare for Josef shidren-shidren, just as shepad dey kare for en sheep. My God wey high pass di angels, make Yu show yor glory wey dey shine
Awa God, di warrior wey nobody dey si, make Yu give us life again! Make Yu just smile for us and wi go dey save!
My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu bring us back to yorsef again. Make yor face shine upon us again and na only den wi go get rest of mind.
My God wey dey diliver us, make Yu save us again! Make Yu nor dey vex for us!
My Oga God, make Yu save and take us back as yor own! Make Yu give us di happiness wey wi get before.