18 Den wi nor go turn from Yu. Make Yu bring us back and wi go pray to Yu!
Ezra go skool and e know di law wey di Oga wey bi Israel God give Moses, well-well. Bikos God dey with Ezra, di king dey gi-am evritin wey e ask for.
and with God help, dem rish Jerusalem for di first day for di fift mont.
My God, I don sofa well-well; so make Yu save my life just as Yu promise.
Make Yu kom fight and protet my life just as Yu promise.
My God, si as yor mesi great rish; so make yor laws dey give mi hope as I dey do dem.
I liedan dey roll for dust; so make Yu save mi with yor word.
Make Yu help mi take my eyes komot from tins wey nor mean anytin and give mi life thru yor word.
I dey wait since to obey yor kommand, so make Yu make my life new again, bikos Yu good well-well.
Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.
Den, wi yor pipol, di sheep for yor field, go tank Yu forever kon dey praiz yor name from one generashon go rish anoda.
Yu nor go revive us again so dat yor pipol go happy bikos of Yu?
Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here! Make di king take mi go en room. Awa king, wi dey happy well-well, bikos of yu and wi like yor love pass wine. Yes, di yong wimen dey honor yu and dat na di rite tin to do.