Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 80:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Awa God, di Warrior wey nobody dey si, wi dey beg make Yu kom back. Make Yu from heaven look kon si di wahala wey wi dey face. Make Yu kare for dis grape tree

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 80:14
10 Iomraidhean Croise  

God dey look from heaven. E dey from der look all di pipol wey E kreate.


Pipol for di world gada round Yu, so make Yu rule dem from yor throne.


My God, make Yu kom back to us! Na how long wi go dey sofa like dis? Make Yu kom sorry for yor savants!


Oga God! Make Yu look us from heaven, yor holy place where Yu dey stay wey get glory. Where yor pawa and strong mind dey? Where yor love and mesi dey? Make Yu nor leave us at-all.


Why Yu make us komot from yor plans and ways? Why Yu make us sturbon like dat, sotey wi turn from Yu? Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu and bikos of di pipol wey bi yor own.


until God go look from heaven kon si wetin don happen.


Who know weda di Oga una God go shange en mind kon bless una with many-many food. Den una go offa korn and wine gi-am again.


Na from una grand-grand papa time, una don turn komot from my law and nor gri obey mi. Make una turn back kom meet mi and I go turn kom meet una. But una dey ask, ‘How wi won take turn kom meet Yu wen wi neva leave Yu before?’


“ ‘Afta all dis tins, I go kom back and I go build David house wey don fall; I go build am with all di san wey skata for groun and e go strong again,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan