Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 8:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 8:4
25 Iomraidhean Croise  

Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.


God sey, “Make lite dey for di sky wey go separate di day from di nite and make sign dey wey go show sizin, days, years


Dat nite, di girls kon make dia papa drink well-well and wen e don high and e nor know wetin e dey do again, di junior dota kon sleep with am.


God kon visit Sarah just as E sey E go do and E kon do wetin E promise Sarah.


God nor dey really stay with human being for dis eart! Si, if di sky and di heavens wey high pass nor rish Yu stay, den how dis temple go take kontain Yu?


Tok-less of human being wey just bi like worm and magot! Wetin dia life mean to God?”


“Wetin bi man wey Yu dey worry for? Why Yu dey borda yorsef with di tin wey Yu kreate?


My God, wen Yu dey show yor favor to yor pipol, make Yu remember mi; make Yu kom near and save mi.


Di Pesin wey make di heaven with en wisdom, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


and di moon and star dey rule for nite, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis? Na ordinary human being Yu dey kare for so?


Make yu nor trust pipol wey get pawa; bikos dem nor go fit help yu.


Dem dey show am evriday and for evry nite, dem dey show en greatness.


Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?


Make Yu support di ones wey Yu choose; di ones wey Yu raiz for yorsef!


Oda nashons god, na just juju dem bi, but na awa God make di heavens!


so di pipol bilive Moses. Wen dem hear sey God don kom save Israel pipol and E don si as dem dey sofa rish, dem kon bow woship am.


All di nashons nor mean anytin to am at-all. For God eye, dem nor mean anytin at-all.


God sey, “Na mi dey give una pawa. So why una dey fear ordinary men wey nor go last pass grass?


E kon ask mi, “Man pikin, yu dey si dat one so? Yu go si di ones wey worse pass dis one.”


Jesus ansa am, “Rabbit and bird get dia own house, but Man Pikin nor get where e go fit rest en head.”


“Make wi praiz Israel God, bikos E don help and free en pipol.


Dem go distroy una and una shidren and dem nor go leave one block on-top anoda, bikos di time wen God kom visit una, una nor know.”


So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan