Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 8:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Oga awa God, yor greatness full di whole world! Yor glory high pass di heavens.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 8:1
27 Iomraidhean Croise  

My Oga God nor dey really stay dis eart! If evriwhere for di sky and di heavens wey high pass nor fit kontain Yu, den how dis temple wey I build go bi to Yu?


I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.


Make all of dem praiz God name. Bikos en name dey great and en glory dey shine for di whole eart and for heaven!


My God, yor love wey nor dey fail, big and wide like di heavens; just as yor goodness high pass di kloud for sky.


My God, make Yu raiz pass di sky! Make yor glory shine for evriwhere for di eart.


Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.


So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!


Oga awa God, yor greatness full di whole world.


Make wi sing praiz God wey bi awa strent. Make wi sing praiz Jakob God.


My Oga God wey dey rule ova evritin, make Yu si as di place where Yu dey stay, fine rish!


My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?


En mout sweet well-well to kiss and evritin about am, dey sweet mi for body. So, Jerusalem wimen! Dis na wetin my love bi like.


Oga God, difren-difren pipol don rule us, but na only Yu wi go dey praiz forever.


God dey kom from Teman; God wey dey holy dey kom from Mount Paran. En glory kover di heavens and na en praiz full di eart.


If David koll am, ‘Oga God,’ den, how e kom take bi David pikin?”


Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”


En wey dem beri, naim still bi di pesin wey raiz-up pass di heavens, so dat e go komplete evritin.


“If una nor gri obey my law, di tins wey dem rite for dis book or una nor gri fear di Oga una God wonderful name,


Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,


Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven


Den I hear many pipol vois wey bi like river and tonda nois dey shaut: “Halleluya! Na awa Oga God wey get all pawa dey rule!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan