So, wetin God tok thru Profet Jeremaya kon happen. “Dem go abandon di land; di land go rest well-well until di seventy years don komplete just as God tok am.”
Siria pipol kom from di east side, while Filistia pipol kom from di west kon surround Israel pipol make dem for kill dem. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
Evribody wey si dem, dey attack dem. Dia enemies sey, ‘Nobody go ponish us for wetin wi do dem, bikos dis pipol don sin against di Oga God wey go give dem rest and wey dia grand-grand papa trust.’