Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 78:36 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

36 But dem dey lie give God kon dey tok anyhow.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 78:36
11 Iomraidhean Croise  

Wons dem hear about mi, dem dey obey. Strenjas and dia kountry pipol dey listin to mi.


God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.


God sey, “Who bi all dis gods wey make una dey fear and lie for mi? Wey make una forget mi like dis? Una don stop to honor mi, bikos I don too kwayet?


Weda wi like wetin God tok or not, wi go obey di Oga awa God wey wi sey make yu help us pray to. Bikos wi know sey, if wi obey am, evritin go dey well for us.”


So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money.


Israel pipol surround mi with lie-lie; na wayo full Efraim, but Judah pipol still trust and dey faithful to God wey dey holy.


Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.


Naw, God get wetin E go tok against Judah pipol. E go ponish Jakob shidren bikos of di way dem dey bihave. E go pay dem back for wetin dem don do.


Di rish pipol among una dey get more money thru wayo and wikedness. Una pipol don too good with lie and trut nor dey dia tongue again.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan