Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
Den di pipol go meet Moses kon sey, “Wi don sin, bikos wi don tok against God and yu. Make yu pray to God make E take di snake komot from where wi dey.” So Moses kon pray for di pipol.
Sisera, get 900 iron war horse and e opress and rule Israel pipol with wikedness for twenty years, before Israel pipol kon kry give God make E help dem.