1 My pipol, make una listin to wetin I dey tok. Make una open una ear, so dat una go hear wetin I dey tell una,
Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.
My pipol, make una listin as I dey tok. Israel pipol, dis na wetin I get against una, na Mi bi di Oga wey bi una God!
I don really sin against Yu; I don do bad tins for yor present. Evritin wey Yu dey tok dey rite and di way Yu take judge my kase, dey good.
My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?
Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok and as yu undastand wetin dem tok,
My pipol, make una listin to mi! Make una listin to wetin I dey tok: I dey tish di nashons and my laws go bring lite to dem.
My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.
Anybody wey get ear, make e hear!”
Una wey bi king, make una listin! Una wey bi rulers, make una hear mi! Bikos I go sing and play music give God, di Oga for Israel.