Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 76:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 E dey honbol prince and kings for dis eart, dey fear am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 76:12
15 Iomraidhean Croise  

God kon send angel go kill all di soja, prince and offisa for Assyria. So, King Sennakerib kon shame go back to en town. Den wen e go en god temple, en sons kon kill-am with swod.


So naw, una wey bi king, make una do wetin dey rite; una wey dey rule di world, make una dey take korreshon!


So God kon vex tok to dem and dem bigin fear wen E sey,


Bikos di Most High dey good! Na-im bi di great King for di whole eart.


So make tanksgivin bi una sakrifice to God, den make una keep di promise wey una make to di Most High.


“Kings and dia sojas dey run!” So Israel wimen kon divide dia propaty.


God dey pawaful as E dey kom from en temple. Israel God dey give pawa and strent to en pipol. So make all praiz bi en own!


For dat time, God go ponish di wiked spirits wey dey di sky with doz wey dey rule as kings for dis world.


Dis festival join di normal Sabat Day and dis ofrin dem join di normal gift ofrin. Dis na ofrin to take do una vow and di ones wey una give God from una mind.)


God distroy many nashons kon skata di walls for dia town. E skata dia street and nobody dey waka pass der again. Dia town don skata and nobody dey stay inside again.


Wen Amor pipol kings for Jordan River west and Kanaan kings wey dey near di wotaside for Jordan River hear how God take dry Jordan River for Israel pipol make dem waka pass, dem kon bigin fear well-well.


Den evribody, both di kings for di eart; di rulers; ofisas; doz wey get money; doz wey get pawa and evry slave and free pesin kon hide demsef for holes and among di mountins.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan