If my papa God, Abraham God and di Pesin wey Isaak dey fear nor dey with mi, true-true yu for porshu mi go without anytin. God si my mind and di work wey I dey do with my hand, naim make am tok to yu yestiday nite.”
For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose.