My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.
Naw, I dey kommand sey evribody for dis land wey go tok anytin against Shadrak, Meshak and Abednego God, dem go kut am, just as dem dey kut leaf kon distroy en house.”
Bikos as I waka round dey look all di tins wey una dey woship, I even si one shrine wey dem rite put sey: ‘To di god wey pipol nor know.’ So wetin una dey woship wey una nor know, naim I kon tell una about today.