9 But for mi, I go always dey tok about wetin Yu don do; I go sing and praiz Jakob God!
Make who sin karry di trobol by ensef; make dem feel God vexnashon.
So I go sing to God as long as I dey; I go sing praiz to my God as long as I dey breath!
All di good tins wey Yu do, I nor keep dem for my heart; but I don tok about as Yu dey faithful and yor pawa wey dey save pipol.
Naw, make Yu save yor pipol wey Yu love. Make Yu ansa kon save us with yor pawa.
Save mi so dat I go fit praiz Yu for publik for Jerusalem gate. Yes! I go dey happy bikos Yu don save mi.
Oga wey bi Israel God tell mi, “Make yu take dis wine cup wey my vexnashon full and make all di nashons wey I send yu go meet, drink from am.
Yu go drink am dry, break am to pieces kon use am take tear yor breast.” Mi, God wey get pawa, don tok.