David ansa, “I dey dance to honor God wey choose mi, instead of yor papa and en family. E make mi lead Israel wey bi en pipol. I go kontinue to dey respet God with my dance
Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.
Bikos to go against am, bi like wen pesin chop witch and to dey show sturbon head, bi like wen yu dey woship juju. So bikos yu don rijet di word wey God tell yu, en ensef don rijet yu as king.”
God tell Samuel, “Na how long yu won to dey sorry for Saul? I don rijet am as Israel king. So put olive oil for yor horn make yu dey go. I dey send yu go meet Jesse for Betlehem, bikos I don choose my king from among en sons.”