1 My God, wi tank Yu! Wi dey tank Yu bikos Yu dey near us and pipol for evriwhere dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do.
I bow kon woship Yu for yor holy temple. I dey praiz yor name, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail; bikos Yu don make yor promise and e high pass di sky.
God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind.
My God, wi don hear am with awa own ear and awa grand-grand papa dem don tell us about evritin wey Yu do for dia time.
Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.
My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.
Una wey dey rule, una dey judge well? Una dey judge di pipol well so?
God don show ensef to Judah pipol. En name dey great among Israel pipol.
Make una listin and obey en vois; make una nor disobey am, bikos e nor go forgive una sins and e dey ansa my name too.
I sey, “My God! Nobody bi like Yu. Yu dey mighty and yor name dey great with pawa.
In-short, e nor get any oda kountry wey dia gods dey klose to dem like di Oga awa God wey dey ansa wen ever wi koll am.