And naw, God don keep en promise. I don bi king for Israel afta my papa and I don build di temple where dem go for dey woship di Oga wey bi Israel pipol God.
“ ‘Make una use mud build altar for mi kon sakrifice una animals and do peace ofrins for mi. Anywhere wey una for honor my name, I go kom meet and bless una for der.
and awa temple wey holy and fine, wey awa grand-grand papa dem for dey praiz Yu before, don skata and dem distroy am with fire. Evriwhere wey wi love, don skata.
God nor sorry for Jakob shidren-shidren, instead E distroy dia house. Wen E dey vex, E break Jerusalem strong fine wall kon disgrace di kingdom with doz wey dey rule am.
E distroy en temple like sey na vineyard kon skata where wi for dey woship am. God make Zion pipol forget dia festival and Sabat Day. Naw, kings and priests don fall, bikos E dey vex.
I tell Israel pipol dis message: ‘Una dey happy, bikos of una temple. Una like to dey look and go der, but I go distroy am and di small-small pipol wey una get for Jerusalem go die for war.’
Di pipol wey bad pass, I go bring and let dem tif una house. Una men wey get pawa go run with fear wen I allow pipol kon skata where una for dey woship.