4 Na for der yor enemies dey shaut and sing sey, “Dem don win.” Na der dem for stand dia war flag.
E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.
God rijet en own altar kon hate en temple. E allow enemies distroy di walls and dem kon dey shaut inside di temple like sey dem dey do party.
E dey perform mirakle and wonders for heaven and for dis eart, E dey diliver and save pipol well-well. E don save Daniel from lions mout.”
“Evribody for Israel must stay with en family; dem must stay near di tent where dem for dey do meetin.”
“As Profet Daniel tok, ‘Bad tins go happen for di Holy Place, inside di temple’ (Anybody wey hear dis word, make e undastand wetin e mean).
Some pipol wey dey der wen Jesus dey tok kon tell am how Pilate kill some Galilee pipol kon mix dia blood with dia sakrifice.
“But wen una si sey sojas don surround Jerusalem, make una know sey di time wey dem go distroy Jerusalem, don near.
So di beast open en mout dey curse God, en name, where E dey stay and doz wey dey heaven.