Den e take di garment wey Elijah drop for am take nak di wota kon sey, “Where di Oga wey bi Elijah God?” Den e nak di wota again and di wota divide into two. So Elisha kon waka pass go di oda side.
Bikos wi hear as God dry di Red Sea for una wen una komot from Egypt and how una handle di two Amor kings wey bi Sihon and Og, for di oda side for Jordan River.