11 Wetin make Yu nor won use yor strong rite hand against dem? Make Yu kom distroy dem finish.
So, my God, make Yu wake-up! Wetin make Yu dey sleep? Make Yu get up! Make Yu nor rijet us forever.
So Oga God, all dis tins nor koncern Yu at-all? Yu nor won do anytin? Yu won make wi sofa pass as wi fit bear?
E vex distroy Israel pipol pawa; E nor gri help Israel wen dia enemies kom attack dem. Just as fire dey distroy tins, na so too E distroy Israel land.
Wen di sojas kom back to dia kamp, Israel leaders kon sey, “Wetin make God let Filistia pipol win us like dis? Make wi karry God Kovenant Box from Shiloh, follow body. If di box dey with us, e go save us from awa enemies.”