God wey save una, di Pesin wey dey holy for Israel, dis na wetin E tok: ‘Na mi bi di Oga una God, di Pesin wey dey tish una wetin dey good. Di One wey dey show una di road wey una go follow.
Den I go always guide and satisfy una with good tins. I go make una dey strong and well. Una go bi like gardin wey get plenty wota and like wota wey nor go ever dry.
Den my favor go shine for una body like morning sun and una sore go kwik heal. I go always dey to save una and my present go protet una for evriwhere.’
Weda na for two days, one mont, one year or if e tey pass so, as long as di kloud still kover di Tabanako, dem nor go komot go anywhere; but wen di kloud nor dey, dem go kontinue dia journey.
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.