Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 73:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 True-true, God dey good to Israel pipol and to doz wey dia heart dey pure.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 73:1
24 Iomraidhean Croise  

So Levi pipol appoint: Heman wey Joel born and Asaf wey bi Berekaya pikin, bikos dem bi dia relashon. Di next pesin na Kushaya pikin, Etan wey kom from Merari family.


King David sey make Asaf and some Levi pipol dey lead di pipol as dem dey woship God for di tent where di Kovenant Box dey and na der dem go for dey do dia work evriday.


Dat day, David first sey make Asaf with all Levi pipol sing dis song take tank God:


Na Asaf dey lead di sekond kwaya and na Berekaya bi en papa. Berekaya na Shimea pikin.


King Hezekaya and all di ofisas tell Levi pipol sey make dem use David and Profet Asaf psalms take praiz God and dem kon dey happy as dem dey praiz and woship God.


“I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”


Na only doz wey get klean hand and pure heart; pipol wey nor dey serve juju or lie or do bad tins.


Wetin make mi nor get hope? Wetin make my heart nor dey happy at-all? But I go still put my hope for God hand! I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!


Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.


My God, make Yu put betta heart inside mi and make yor spirit strong inside mi too.


True-true, God put dem for di road wey dem go for fall kon make di groun for di hill wey go distroy dem, draw dem fall.


My God, make Yu nor kwayet just like dat! Make Yu nor rijet us! Nor just do like sey e nor koncern Yu!


Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.


“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?


God go bless una wey get pure heart, na una go si God.


“Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.


Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am, e kon sey, “Make una look! Dis na betta pesin wey kom from Israel, wayo nor dey en belle.”


Na dis one make God promise dey kom by faith and wi dey get am thru favor. Nor bi only pipol wey dey obey di law bi Abraham shidren, but pipol wey bilive God like Abraham, naim en shidren dem bi too, bikos na Abraham bi awa spiritual papa.


E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.


Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, make una wosh una hand and una wey get doubol mind, make una heart dey klean.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan