Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 72:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Make di king rule from sea go rish sea and from Eufrates River go rish di end for di eart.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 72:8
10 Iomraidhean Croise  

King Hiram for Tyre, na David friend, so wen e hear sey Solomon don bi king afta en papa, David, e kon send some pipol go meet am.


Make yu ask mi, and di pipol wey dey dis world, I go give dem to yu as yor propaty and evriwhere for di world, go bi yor own too.


Before-before, wi spread go west for Mediterranean Sea and Eufrates River.


I go make am rule many kingdoms and en pawa go strong well-well.


en shidren-shidren go bi king forever and en kingdom go dey forever like di sun.


Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.


God sey, “I go remove di shariot from Israel, den take di horse dem komot from Jerusalem and distroy evritin wey dem take dey fight war. Una king go make peace with oda nashons. E go rule from one sea to di oda: Even from Eufrates River go rish where di eart for end.”


Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan