E go judge and setol kworel among nashons. E go setol many pipol kase. Dem go turn dia swod to ordinary blade kon use dia spear dey work for vineyard. Den, no nashon go fight against anoda nashon and dem nor go train pipol to fight war again.
Even una small family wey dey honbol demsef, go dey great like nashon wey get pawa well-well. Wen di time rish, I go make dis tins happen kwik-kwik. Na mi wey bi God, tok am!”
For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.
God sey, “I go remove di shariot from Israel, den take di horse dem komot from Jerusalem and distroy evritin wey dem take dey fight war. Una king go make peace with oda nashons. E go rule from one sea to di oda: Even from Eufrates River go rish where di eart for end.”
But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.
All di pipol wey bilive Jesus Christ kon dey do tins togeda with one mind and nobody sey e go use wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propaty togeda.