Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.
Den I sey, “My God! Na Yu dey protet and give mi pawa. Yu dey help mi anytime I dey for trobol. Nashons go kom from evriwhere for di eart kon sey, ‘Di gods wey awa grand-grand papa dem get, na only to lie dem know and dem nor fit save anybody.’
Joshua di High Priest and all di priests, make una listin to mi, na una bi my sign about wetin go happen; bikos I go soon bring my savant, wey bi di Branch!”
Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept.
Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka.
Bikos e klear sey, di place wey God give us wey bi en apostles, na where worse pass for di world; wi bi like prisonas wey dem dey go kill. Angels and dis world pipol just dey take us make yeye.