So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.
God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”
En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.
But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere.
So, Christ don make awa mind strong. Even as awa heart don strong rish, wi dey happy more-more for Titus wey kom, bikos all of una don let en mind rest.
Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”