Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 71:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Make Yu kom take and save mi, bikos Yu dey do wetin dey rite. Make Yu listin and diliver mi.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 71:2
12 Iomraidhean Croise  

My God, make Yu hear my prayers; make Yu listin as I dey pray! Make Yu ansa mi, bikos Yu dey good and evritin wey Yu dey do, dey rite.


My God, make Yu save mi, bikos of di glory wey dey yor name. Save mi from dis wahala, bikos of yor faithfulnes.


Show sey I dey innocent, bikos Yu dey si doz wey dey rite.


My God, I dey pray to Yu, bikos I know sey Yu go ansa. Abeg, make Yu listin to mi as I dey pray.


My God, na Yu dey protet mi; so make Yu nor let pipol disgrace mi. Make Yu save mi, bikos Yu dey always do di rite tin.


Make Yu listin to mi kon kwik diliver mi. Make Yu bi my rock wey go dey protet mi; di strong place where I fit hide put.


Pipol wey dey do wetin dey rite, God eye nor dey komot from dia body and en ear dey open to hear wen dem kry for help.


My God, make Yu show sey I dey innocent! Save mi from pipol wey nor dey fear Yu. Diliver mi from doz wey dey lie,


Before-before, Yu dey defend us. So make Yu nor vex for Jerusalem again, bikos na yor town and holy hill, e bi. Doz wey dey stay near us, dey look Jerusalem kon dey laf yor pipol, bikos of awa sin and di wiked tins wey awa grand-grand papa dem do.


E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan