Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 71:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 My God, yor good judgement dey rish di heavens and Yu don do many wonderful tins, so na who bi like Yu?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 71:19
20 Iomraidhean Croise  

Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.


Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!


I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey: “Na who I wont take kompare with my Oga God? Na who go fit save pipol wey nor strong from pipol wey strong? Na who go fit protet pipol wey nor get help and poor pipol from tif?”


My God, si as I value yor love wey nor dey fail! Evribody dey save under yor feada shadow.


Bikos yor love wey nor dey fail, high pass heaven. Yor faithfulnes dey rish di kloud.


Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.


My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!


My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?


Wise pipol dey waka for di road wey dey lead to life and nor bi di one wey go take dem go grave.


Wise word too deep for foolish pipol to undastand. So wen ever pipol dey tok about sirious matter, foolish pipol nor get any betta tin to tok put.


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


Who dem go fit use take kompare God? E get anybody wey bi like am?


Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol, dem go praiz am and afta E don judge all of dem, evribody go know sey Oga God get pawa well-well.


As heaven high pass di eart, na so my ways and di way I dey tink, high pass una own.


E nor get who nor dey fear Yu, bikos na Yu kreate evritin. Nobody bi like Yu for di whole world. Even kings and wise men nor rish Yu.


bikos E don do big-big tins for mi and en name dey holy.


“My Oga God, yu don start to show mi yor pawa and how Yu strong rish. (Na wish god for heaven or eart go fit do wetin Yu dey do so?)


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan