Wi nor go hide dis trut from awa shidren; wi go tell di next generashon about di good-good tins wey God do, en pawa and di wonderful tins wey dey sopraiz us.
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
As di man koll God Kovenant Box, Eli kon fall from en chair go back near di gate. En neck break and e kon die, but e don old well-well. E judge Israel pipol for forty years.