For anywhere wey Jew pipol dey start for di town, dem kon gada demsef to fight anybody wey won fight dem. Pipol for evriwhere dey fear dem and nobody gri near dem at-all.
But God wey strong and get pawa, dey my side. So doz wey dey plan against mi, go fail. Yu go disgrace dem forever, bikos dem nor go susid and dem nor go ever forget di disgrace.
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.