2 Make shame and disgrace follow pipol wey won kill mi!
Make disgrace follow pipol wey dey akuiz mi; make shame kover dem like klot.
My Oga God, I dey koll Yu, so make Yu kwik kom! Make Yu listin wen I kry to Yu for help!
My enemies gada round mi like strong melu and wiked animals from Bashan. Dem gada won bite mi!
Make Yu save mi from di swod kon guide my life from doz dogs.
Make disgrace and shame follow pipol wey dey happy sey I dey sofa. Make nobody honor doz wey dey dance, bikos I dey sofa and make shame kover dem.
Make shame and disgrace follow pipol wey dey try to kill mi; make Yu drive dem back and disgrace doz wey won wound mi.
Make shame and disgrace follow di pipol wey dey try to distroy mi. Pipol wey dey happy bikos I dey sofa, make disgrace follow dem.
So make disgrace follow all my enemies and make dem dey fear well-well! Make dem run turn back, go hide with shame.
So, my God, make Yu nor leave mi, but make Yu hurry kom save mi.
Make Yu disgrace and distroy pipol wey dey akuiz mi. Make disgrace and shame follow pipol wey won kill mi.
So God word nor make sense at-all to dem and na dis go make dem fall wen dem try to waka. Yes! Dem go fall for trap kon wound and dia enemies go karry dem go as prisonas.
Pipol wey dey vex with una, go know how pesin dey shame rish wen dem don defeat am. Pipol wey dey fight against una, go die
So wen Jesus don tell dem sey, “Na mi bi di pesin”, dem dress go back kon fall for groun.