Dem neva go far from di town wen Josef tell di savant wey dey kare for en house, “Make yu porshu dem at wons! Wen yu katch dem, tell dem sey, ‘Wetin make una repay bad for good?
Yu take Saul kingdom and naw, God dey ponish yu for all di pipol wey yu kill for Saul family. God don give di kingdom to Absalom yor pikin. Yu don fall; yu wey dey kill pipol anyhow!”
David run go Naiot for Rama. E go meet Jonatan kon ask am, “Na wetin I do? Na wish bad tin I do? Na how I take sin against yor papa? Bikos e won kill mi!”
Ahimelek ansa di king, “For all di savant wey yu get, na wish one dey good rish David? David na di king pikin husband, na en bi oga for di king sojas and e dey work for yor house.
Saul kon ansa, “David my pikin, I don sin! Make yu kom back. I nor go kill yu, bikos yu don save mi today. I bi like fool today and I don make big mistake.”